My smile has widened......
My steemit pipu, I dey troway salute o, Una wehdone. Na dey folo una yarn so. Anty
na beta hail I dey hail you unto sey you sidon reason this matter wella.
I neva too tey for hia but the plenti plenti tins wey steemit don do for me dey burst my brain, I dey tell you.
Hmm, my pipu. You see this one month wey just troway leg waka so? E don change me. I no been dey sabi read plenti tins o but steemit don do I dey read anytin; signboard o, book o, even newspaper wey the woman for my yard dey carry package sumtin sell gimme, I dey read am weda yarns go komot make I knack small post for here.
I no even wan yarn una unto time matter. Steemit don do wen I standa for morning I go dey write the tins wey i go do make I get time to drop sum kind tins as posts and comments.
If I no talk this one ehn, somtin dey wori my head. Steemit don do I dey follo people wey I for no sabi talk. Dem too plenti, I no go fit dey tell una all of dem name; for wey dey do hub give us,
wey dey comot smoke for my head with better better talk unto health matters; I hail una.
Tins brekete full ground but make I just drop this last tori comot. Steemit don do I no dey wait make my palé and malé drop small bar before I fit do som kind tinz. Na me even dey drop light change (for now) give dem make dem take coolé. If you bin see me for Christmas day ehn, as I dey do better big sis give my junior bros, dey buy anytin wey he wan chop give am....chaii e bin dey sweet me for belle.
Make I come dey go o. Now wey you don hear my tori, op sey you go follo yarn your own make I fit see.
Collect the link here
https://steemit.com/npc/@ogoowinner/naija-pidgin-challenge-make-una-tell-us-why-una-like-steemit