How una dey my people? How every nah?
Ise obinrin ni (na girl job).
I no know how e be for your side oh but for my side here for Naija, people get the mentality say certain jobs and house work na for girls.
[Source: my phone]
A family wey get 3 boys and 1 girl go expect say na the girl suppose dey cook and sweep for house unto say na girl job.
As girl don dey reach 5, 6, 7 years, im mama go begin carry am go market say make she sabi how to price things and buy better come house when she don grow. When im mama dey cook, she go dey inside kitchen dry carry salt and seasoning.
I been remember dah year for hostel, na me be the only girl for our lodge, make my people sweep na lie, dey go tell me say na girl job; make dem cook, na war, dey go still tell me say na girl job
How we go change this mentality for our society? No be only girl suppose know how to do house chores, we gather dey live for the house, dey chop the food.
Naija.ng
The one wey dey pain me pass na when boy and girl do the same thing and them papa and mama gather dey yab the girl like say na girl come dis world come suffer. Some families self still dey get course wey na only boy fit study; engineering, mathematics and medicine for boys, law and nursing for girls.
How we go change this na girl job nah? As a girl, wetin you dey do unto say na girl job?