Hausa go talk say Ina' kwuana
Igbo talk say Otutu oma
Yoruba talk say Eka ro'
Ibibio say Mmesiere
The Gbagi say Gu lemo'gon
This one way i commot for bed come see this betta talk, i say make i follow shook mouth put inside oh.
The things wey this ogbongeh community don do for me as i dey follow u yan no be small oh!
I just carry my two two legs commot for university just last year. Dem don follow gimme certificate but them no gimme Sabiticate.
As i dey here they gist you so, don commot sabiticate give me ynaffu ynaffu.
Comon to write for face book dey tire me. But for here (), i dey put my matrass untop the mata. Dem dey pay me to talk? I even tell my family pipu say i don dey work with american company wey dey pay me in dollars, them begin laff. But wen i commot my first salary cook food for house, everybody come dey ask for link like say na ultimatecycler! Lol
If u no dey inside this steemit something, then dem dey follow you for village oh.. Cos how person go spend money untop data come no dey use am do beta tin?
Any how sha, this steemit wey u see so, no be today dem begin beta my life oh... I don dey chop food steady because of steemit oh
Akwaibom pipu talk say "abasi udiong "
Well i no fit forget to follow thank pipu wey carry hand show me love.. Pipu wey commot me from ignorance bring me come light! Una do well oh..
Others wey don follow me talk wen i been no wan do am,
make God shower blessing untop una family all oh...
Well na naija be dis and we must to promote this community wey u see so. Until our village people go follow us dey blog!
Un do well.
Make i carry my own commot go my papa domot!