MY PEOPLE! MY PEOPLE!!
I Don land again oooo
How Una dey? Happy Sunday!
As usual I waka with my Oga at the top, my show husband to come announce the part two of naijapidgin variety show today by 6pm at the usual usual... our naijapidgin discord channel
Mehn! Last week sweet die! Infact I no dey talk much today, if you know you know...
You know as Ih dey be na... Oya let's go there!
Today show go take another shape ooo
Talent and quiz go join together so that make people no sleep for road...πππ
Last week people carry new new talent con dey intimidate people, so tey some fear run commot after them hear talentπππ today Ih be like say person go build house seff for the show πππ
Abi na singing talent Una wan show us?
Abi na the usual bad belle talent like the untalented...
We dey welcome all of these performances.
No even yarn say you dey fear quiz...
Afterall use tumbumtumbum take win πΆπΆπΆππππ
Abi na spelling error talent you get like some participants... π―π―π―π― make I shut up oooo before them block me for road. πππ
Abeg come one come two... we need Una...
Above all fun full ground remain! Laugh laugh, cry cry, joke joke, mumuism, badbelleism... all in one.
No forget say our Mamas dey gidigba and
as our overall!
No forget another hotseat go dey after the show. You know as the last one been dey with our boss .
Below na proof of payment to the last winners... this time many double go dey
This other one na those, wey resteem get am
Oya if you know yourself rush upvote, comment and resteem sharp sharp to claim your package.
**Our senior men and women for naija Steemit, Afar na? We dey wait for Una sponsorship ooo. Abi Una dey find courtesy visit?** π’π’ππ Abeg no open that kind leg oooo. Meet our Mamas for