Na yesterday Na im me and my padi dey discuss . Im come tell me about the contest wey our madam at the the top
dey organise. E pain me say I no follow for the first one but I come talk say this one no go escape me.
Friendly enemy Na im oyibo people call
wolf in sheep's clothing
.On a norma, I no be persin wey dey too get friends like that but e get this boy wey dat time e be like say dem tie our matter for heaven.
Na so me and dis boy come become padi-padi. Anytime wey I need anything the boy go help me. Im be my personal adviser.
So one day my papa come help me apply for scholarship so I go go obodo-oyibo (America ) go do university.
Na so I come tell this my padi (uche) about the scholarship. Im come dey discourage me say all dose scholarship Na scam.
Wen the exam day reach , I go write the exam. Two weeks later the result come out e come be say I pass the exam. All Wetin remain Na make I bring my waec result and other documents.
When we come day write last paper for watching, uche wey I tink say Na my padicome sit down beside me.
As the invigilator come dey Waka come my side uche carry mgbo ( a small paper in which answers have been written on) throw for where I sit-don, come dey shout say I dey do expo.
Na so dem pursue me comot for the exam. By the time results comot, e come be say dem seize my result because of malpractice.
My people Na so I miss the chance to go study obodo-oyibo (America). Na im I come write gce, buy jamb form come apply for university of Nigeria (unn).
Now, I dey 300l ,dey study banking and finance for unn while uche don relocate go village.
Wetin uche do pain me but then Na God sabi pass.
Na picture of me for federal Palace Hotel for Lagos Na im I upload.