My contri people I trowey ogbonge salute for unah o!
How unah dey?
How unah take dey hold body for this we change we dey touch every body so?
Today we don come again with another matter wey we want make unah for chook mouth put.
This matter don tey small but I still want make we reason because the matter just the surprise me how federal government take the play us like 10 10 for this we country
When APC been want enter government come run our country matter nah so them promise us heaven and Earth sotey....... baba promise is say one of the matter wey him go carry serious with red eye nah the matter of people wey carry our country money run chop am with them family wetin oyinbo dey call corruption.
Nah so naija carry power give them we no come hear anything our naija information minister go come outside talk this one, federal government go come outside talk another one sotey dey matter tire me
Nah em recently federal government come put one list for online say nah the names of people wey chop our county money make we read am even as them know say we no go fit do anything nah just to read we go read am.
Wetin the shock me be say nah only naija person go steal 1billion with pen and paper Dem go catch am em go come use 10million bail himself.
Abeg country people unah think am say nah the right thing them do?.
Abi unah think say this name wey them release fit help us fight this corruption?
Abeg make we yarn like one naija wey we be