Naijapidgin Una weldone o
Today na Friday oo, I know say some of us don dey ready to flex, ah market don dey green small small, so to flex no go hard..
As e dey hot! naijapidgin don carry another matter come today, and this matter dey weak person ghan!
Omo this world don spoil finally sha, e get one man for Lagos wey dey 50 years old, the man go give e pikin wey dey 21 years old belle. The man dey carry the girl dey waka up and down like say e be e babe, they come dey do relationship. Casala burst for their head wen the girl carry belle, na e the man wan begin try kill himself. E first jump inside well, neighbors remove am, he try hang himself, people stop am, finally finally e wan drink insecticide make e die like mosquito but the neighbors stop am. Na e landlord wey e never pay carry am go police so that e go fit pay am as to die don dey hungry am. Na dere wey the man begin talk.
The thing wey weak me pass be say, the man talk say na e pikin rape am, plus devil wey put hand join for e life.. I tire, how pikin go rape e papa? I believe say man wey dey 50 years never too old, atleast e dey strong, so how the girl come rape am? Why e be say anytime wey person do bad thing e go dey call devil like say dem two dey live for house?
Abeg make una help me reason this matter o..
Una believe say the pikin wey dey 21 years fit rape e papa wey dey 50 years?
Why people dey always blame devil wen dey don catch them for their bad thing?