My country people,
Well-done o.. How una dey hold body for this naija? Hope say una don dey ready una PVC for net year? No dulling at all
Today na another Friday, naijapidgin don carry ogbonge tori come again.
source
Una know say plenty things don dey happen for those people wey just commot from big brother. Many of them don dey get job up and down. The one wey shock me be say, IMO State Governor, Rochas Okorocha don make Miracle, the guy wey win the show Education Ambassador for Imo State. I happy for am because me self like the guy, but wetin I no understand be say, how big brother show take concern education? How e fit represent Education? E get wetin dem dey call Scholars for that State but the Governor no dey even look their side.. How Miracle win take help Nigeria and Imo State?
E get other government work wey fit big brother, e.g Culture and Tourism. At least dey for make am Ambassador for Culture and Tourism, e for make sense pass. Na this kind thing dey spoil our countri, to dey put people where dey no suppose be, abi naijapidgin wetin una think?
Make Una help me reason this matter.. Una think say IMO State governor do better thing? Una think say Education Ambassador go fit Miracle pass Culture and Tourism Ambassador? Make una chook mouth for this matter because me sef dey confuse.
If you no dey our whatsapp group, come join here
Na carry this matter come
Na design this avatar