My country people una good morning. How una dey? This cold reach una side because e be like say na everywhere for we country this rain fall Sha. Rainy season don land again, make una dey carry umbrella and extra shoe Waka o. Remember how we road be for naija.
The matter wae jam us today na about babe wae donate kidney for man
I de play online nai I see wae this boy wae be footballer so all tru is time wae he de play ball he developed kidney problem and the guy just de manage as e see small small money for the ball wae e de play, so time come reach wae e be say him not fit manage again and the doctor wae de help am tell am say he go need another kidney or he go die.
So this boy mama don find people wae go donate them no see and him papa no gree make him sister donate... As him babe see am say him matter don de bad, the babe come say him go donate... Even the girl mama say make him no do am say she fit die but love Matter catch the girl and she no tell anybody come finally donate
So recently the babe go de cry Because the guy tell am say him no fit date am again say him no like the babe wae donate kidney again.. Even me sef shock say which kind heartless person b this one.... Because the guy say him no sure if na God plan for him life
I wan ask if he de possible as a guy say u go stop to de love girl wae dash you kidney and if you be girl watin you go do
Personally first me I no go even drop any kidney
Abeg I wan hear ur opinion for this matter