Naijapidgin: my country people. Una godmorning o. Today na another Saturday and una know as we dey do am abi? Na our naijapidgin hot seat and who we get for we hotseat today na no other person than .
, we welcome you o. oya talk make dey hear your voice.
Mimy: 😁😁 naijapidgin una good morning o. How una dey?
Naijapidgin : I go answer for them. We dey fine and we no fit wait to see wetin you carry come for us. You Sabi tear pidgin abi?
Mimy: No be im I don dey tear?😁😁
Naijapidgin: okay now. Nothing dey happen
Mimy: LOL... 😂oya
Naijapidgin: okay so before we start wella, abeg yarn us who be mimy. How that name mimy vanilla take happen?
mimy: 😭Hahahaha. I don enter mood now💪
Naijapidgin: Take popcorn 🍿.. Make u no Choke
Mimy: Clears throat... Make the Tori begin, plenty people bin they ask me say shey my real name na Mimy abi na Miracle anyway, cat wey enter bag, don ready to jump out. As una see ehn, that name don follow me come since secondary day. This Tori go funny una, so e happen say, one day I carry Indomie go school, hunger nah mad woman sha, na im hunger come dey waya me for class, I come open my locker dey still the indomie small small, for my face, I wise be that o, to cut the tori short, teacher come catch, e con tell me say make I stand up, o boy, shame catch me, wetin I hear next? What are you eating? With my small pikin mouth na as at then, na Im I Jejely talk say "Mimi Noodles" Lol, Class scatter, everybody throw way laugh. So na since that time them dey call me Mimy and apart from that my real name begin with "M" so E flow with Mimy wella.
Naijapidgin: Even me I don de laugh here #indomie mimy
Mimy: 😭😭😭...... Lol
Naijapidgin: Another question. We know say you be double.... I mean say u be double But e get another Bobo wae I hear say na your bro for this steemit Na true?
Mimy: Lol, True yan! Na true. Im username na
Naijapidgin: na I'm be say steemit na family business for una. So who introduced you come steemit or how you take know about steemit?
Mimy: 💃.......... Hehehe.... This one sweet me wella. Na my Chocolate invite me come steemit as I dey like to call am; Baby'm Ehiboss.
Naijapidgin: Hehehehe...... This love no be jackin chain ooo...... Na indomie love.
Oya make we enter watin u like to do.We know only one wae be "Drama".Which other one you wan tell us? And I go like know why you like drama
Mimy:😊. Lol... Okay, na since when I small I don know say I must to enter theatre. since when I small na im I don dey write stories, dey do drama especially during end of the year party for primary school. People go just dey look me say, "Chai, who be this small pikin"
I like drama because I just like am! I no fit explain, I dey passionate about am. I wan tell stories! Drama na beauty! Drama na the Koko! Drama na life.
Naijapidgin: OK I see now...... D drama club
Mimy: Unapologetically feeding your eyes!💪🐹😂😊
Naijapidgin: Na recently you lunch d drama abi e don tay? D drama club na for only steemit abi na anywhere we fit call una?
Mimy: Na God go bless you for this one wey you throway give me. Na for steemit I launch the DeDramaClub. For this life ehn, person suppose follow person passion, person talent. See make person no dey wait, I put my hand for chest, nak am three times: I tell you "Make you start now, no dey wait for future, the future na now" Time na usain Bolt, E no dey wait for anyone.
This na me the reason why I start DeDramaClub because I no say na the path to my future.DeDramaClub no be for only steemit. When I create am, my vision wide from here reach...... By God's grace my plan na to dey produce my own films and as I dey go, na im I go carry DeDramaClub likiri pikin with me.
Make una feel free to invite us. Them dey call something travelling theatre, by God's grace, this one too follow join my Vision for DeDramaClub.
Naijapidgin: Oya make we go back to steemit matter. We wan learn one tin Recently people de argue about power up and cash out.Wetin you go tell people wae de depend on steemit for money.... Like students na because everyone go de advice make we power up
Mimy: For my own mind, wetin I think be say na to cash out pure pass.
So make you cash out, carry your money for bank, dey save am for future needs, daily needs too join am. Steemit na blessing, make you gather all those money take am use establish business offline.
Na the reason why them take divide Payout into Steem and SBD.
For that power up, many small fishes, them see am as an avenue to get vote for themselves but how many steempower u fit build with small SBD. If you wan power up, power up because say you see am as future investment, money wey you save for somewhere.
Make you cash your SBD out and once in a while, you fit power up.
Naijapidgin: Thank you
Ehen me sef don reason am. Say how many power up wan give me 0.09$ but this one wae you talk say save you money for bank meet me wella
Mimy: Lol... Make E hit you wella o.... Make people dey learn from other people mistakes. Na plenty times I dey hear people dey complain say they get money online but dem no get offline. Make you build your offline money, E dey very crucial. No carry all your money enter crypto, all these big big people wey dey invest gbagada, dem get something tangible offline. So make you play your game wella.
Naijapidgin: Oya back to matter wae concern you wella... I know say you make me feel like say.No vex ooo.......🙈
Mimy: 🐹..... Lol
Naijapidgin: some people de fear blockchain love because my wallet de open..... Babe know watin you cash out and watin de ur wallet.Shey you advice blockchain love because me I de look your twin side 🙈?
Mimy: Lol, My own love na everything, Blockchain love, steemit love, genesiproject love but most especially True love. Lol. No be for steemit, I meet my Chocolate sha. na my childhood friend, we dey write love letter give each other that time. I don know am for more than ten years now. Nothing do blockchain love. The only thing wey I go advice na say, make you dey true to yourself. When you choose person, make sure say you fit connect with that thing wey person no fit see at first glance. Money and Beauty no fit hold love.
Naijapidgin: No wonder when those babe de call ehiboss their crush... They guy no send them and your mind rest...... Na strong matter
Naijapidgin: Shey you know say u don inspire many show for steemit... Mayb you no know. Tgif, Saturday night, Wcw
I no wan put the name of people wae de incharge
Mimy: Lol..... Ikr🙃
Naijapidgin: So my question na watin inspire NDJT
Mimy: Hahahaaha..... NDJT! NDJT, this one just make my heart race with love.
One night, I just sit down they think sey wetin I fit do. I get this quote make I talk am for Queen English "No one would know you or about your existence until you say, here I am" This world be like stage, every body they shout, dem they talk, different music dey play, them shaku shaku queens dey dance, so; WHERE YOUR OWN VOICE?
How you want take make yourself visible among people wey we no fit count finish?
I like to dey unique. I like to impact. I like to dey motivate people.
All these things join, na im put NDJT for my head.
Naijapidgin: 😂😂😂😂.... You even de motivate me. As you de talk to me sef I don learn pass as I know before...... The idea de brilliant
Naijapidgin: Wetin be you advice for upcoming minnows for steemit.
Mimy: Okay, make you no give up on steemit. One tool wey you need very well on steemit na your fingers,Make u use am wella. Make you build positive relationships. Your SP fit dey small but I tell you, your mind, your capability, your imagination and wetin you fit deliver big pass steemit.
Naijapidgin: my naijapidgin people una don hear am? say make una go give up. Use your fingers well.
Naijapidgin: E sweet us as you honour us today come we show this morning. We no want let you go but we no get choice. Before you go, oya translate this tin to pidgin for me...... : " NO ONE WOULD KNOW YOU OR ABOUT YOUR EXISTENCE UNTIL YOU SAY, HERE I AM"
Mimy: "Nobody go no say you exist until you talk say " Yes, I don arrive" 😒
Naijapidgin: You be true true naija born.
Mimy: 😊Thank God😭
Naijapidgin: You fit make one shoutout to any steemian apart from ?
Mimy: Sure☺.Okay, , wherever you dey, I give three Gbosa to you!.
Naijapidgin: we don come to to the end of the show. No be small laugh I dey laugh here. we enjoy you and we know say people wey dey read dey enjoy you too. We want say thank you say you come.
Mimy: una do well as una invite me too. I enjoyed am well well. Naijapidgin I hail una.
We don come to the end of the show. If you get questions for abeg ask am for comment section she go answer una.
Na so we dey do am here o. next week we go bring una another OGBONGE visitor. Na only for naijapidgin una go dey see all this Kain sweet sweet things. If you never join us for whatsapp oya wetin you dey wait for?
Join here 👉whatsapp