Una good morning o my country people how the weather dey for una side as we don enter rainy season everywhere go dey cool.
Today na Wednesday the middle of the week and I sure say people don reach office since even students too don enter class.
Na one tori I carry come for una this morning wey my eyes jam and I wan share am with una na one fine Ghanian shenkes na im talk the matter her name na Zipporah.
After all the plenty plenty story say men no good and men na evill people na im she talk say as for her o after several heartbreak the Nigerian man when she dey date presently na him dey give her joy intact say before she meet the bobo she always talk say all men are the same but when she jam the bobo her story change.
She even talk say Nigerian men no dey beat woman say instead of them to beat woman them dey waka comot,na so she just dey hail them so she con advice Nigerian women say make them dey appreciate their men because na them be the best for Africa
Abeg my people wetin una get to talk for this matter,na true say Nigerian men na the best?
Make help us chook mouth for dis tori....