My people, my people
Happy new month o
I dey wish una better better things for this new month
Today na Friday, I wan make we talk entertainment gist. E be like say dis 21st century dey carry madness come, we don too copy yanki people so tey our own madness wan pass their own.
Source
I just dey luk pictures for my Instagram, I come see this picture, I come dey wonder how wizkid go dey hold mad woman for stage, how d mad woman take enter. I say make I read the tori, na so I just read am come see say na our own Tiwa savage wey dey stage for U.K.
Ahh, Tiwa don dey mad? She even put chain to complete am..
The thing wey tire me be say, some of our youths come dey hail am, some pipo even dey talk say if na Beyonce or Rihanna wey wear am we go dey hail them, but we no fit hail Tiwa ... Which kind talk be dat? Madness get country?
I feel say bad thing na bad thing, abi no be so, my people?.. Wetin una think? Make una come chook mouth for this matter, this kind thing wey Tiwa wear, e dey good? Even if na Beyonce wear am, e dey good?
Make una come talk, I wan hear una own today..