We dey hail o!
My country pipu i hail una dis ogbonge weekend morning. I wan believe say una turn up for TGIF yesterday night and na so the jollification go dey continu as we dey groove inside the weekend.
The mata wey dey ground today sweet me for belle and i sure say your belle go sweet too.
Una sabi say we naija people be correct pipu, we strong and we sabi hustle wella, we no sabi dull na why we no understand am wen dem call us "lazy". But also we sabi say plenty plenty suffer dey inside this we country, some things no dey work and some tins just tire us!
But today i wan make we talk one better thing wey we dey enjoy for this we naija becos me i sure say some inside this our suffering e still get wetin dey make us smile!
Harmony inside hustle
Make i talk my own...If i go visit my mama for market, sometimes one of the women go born pikin na so all these women go dey happy and their celebration na to dey dance and carry white powder dey rub for their body and face!...this one dey show unity even inside deep poverty and e dey sweet my belle.
I go come finish my own with the free cinema movie wey i dey always enjoy inside naija bus...chai, this na why i still neva travel go abroad.
Even if i don tire, the kind comedy wey i dey get for inside bus dey alwayd bring me joy.
My pipu abeg make una come tell us the sweet things wey una dey enjoy as we dey hustle for we naija!