As per say today na friday, naso i reason say make i use ibile dress yanga for mah foto.
Eli momo today, as i dey jam konplain gv my guy () say i no geh post wey i fit drop ontop steemit today na sote e hala me say naija pidgin contest dey ground. Naso me sef reason say something na something, if na shikini amount dey ontop am , at least sometin sha don dey ground for me niyen.
Now, ontop mah love mata for steemit. Why i love steemit sote be say steemit don help me in many ways. Steemit don make me proud as per say i dey gada write ups wit my brain, steemit don make me sabi say ah fit contribute to my society and the world at large. Me sef don turn boss for mah guys face, as per say i show dem way for steemit.
Make i no be like pesin wey dem show how to dey catch hin own fish wey no kom dey grateful, my boss , na only God fit pay una back for me, wetin i wan do wey go reach ??
Aunty , more grease to una elbow.
My people, make una no dey look ur pikin like dis ooo, helepu me upvote this thing abeg, make me sef see beta thing chop for this thing.
We go dey see later na ...😉