How una dey my pipo? January don come pipo don begin shout as usual. Dem dey talk say January too long. But me and you know say that one na lie sha.
Pipo go spend their money anyhow for December, den begin shout say January too baby. That one na lie. January no long at all. Na the same thing with other months wey get 31 days.
Naija people make una learn how not to dey waste money anyhow, then come out come begin to dey complain up and down.
Wisdom ein good for everything. I don write finish for now.