P/s: This blog post is written in Nigerian Pidgin English
Hello My Fellow Nigerians in Madam Patience's voice. Hahahha
Una don't see the recent and viral video weh just land for this our country again.
Imagine ooo, this wan na Inspector General sef of police in Kano wet dem say make him read speech for the commission of the Force Intelligence Technical Unit on Monday. Him com dey fuck up.
Chaiii... Nigeria no go better again.
After now BuBu go come talk sey we the Nigerian youths are lazy when these lazy ones sef better pass the people dem dey put for office. At least we sabi read and write English wella.
My dear. Na so Dis man dey pronounce nonsense since ooo. Nothing bin happen to him before dem call him out ooo. But as him just land dey begin dey read speech...Gbagam! His village people follow. Him come dey do
I mean transmission.... Ghffbabbsnsjdbe effort jjshsbsueb sorry sir sorry sir... *Iweep*
Na so one good Samaritan come help him out dey read d something for am while him repeat after am like one nursery school pikin wey dem wan teach how to read and write.
This country na real Joke we dey.
Make una go get una PVC ooooo
Meanwhile, If you from Nigeria come... no forget follow this beta pikinI remain your steemian beauty Queen ...lol