Una good morning my country people. Today na Thank God it is Friday as oyibo people dey talk am although me never know why na only Fridays Dem dey thank God but dat one na Tori for another time.
E don tey wey we do contest for we blog and I know say una phones dey cry for recharge card na im make the good people of naijapidgin come decide say wetin we go do to make una smile again?
Yesterday na international women's day. Everywhere you go the news full ground so today we for Naijapidgin still want celebrate women and that na im be today matter.
Wetin we want make you do?
Just upload a picture of any special woman for your life. E fit be your mother, your sister, your friend, your lover sef. Just upload the picture den write one sweet message to wish am happy women's day.
As usual, na for our telegram page by 9pm this night we go select winners wey we go sama their phone with recharge card.
Wetin you dey wait for?
To participate, first upvote this post and join us for our telegram for here