My country people, how una dey? I trowey ogbonge salute come una way o. Today na Thursday again and the last Thursday for the month of August. Hmm! This month be as e get o. From beginning till end na so so katataka for my area but I believe say una side bam wella. Anyway Sha, e don dey quarter to go and next wey una go see me on top this matter e go be September.
Una don ready for me today? Wetin I get to yarn una? E no get wetin I want yarn una instead na fun time na im I don carry come una side o. Wetin e be? Na very simple thing I want make we do this morning. I dey in a good spirit to dash person 2 steem but before I dash you the 2 steem, you go must do something for me.
Wetin you go do?
I no know how much be 2 steem now for we money but e go be around 500 naira. So if I give you 500 naira make you cook food for me, wetin you go use that money cook for me assuming say you get other ingredients for house.
List all wetin you go buy and how much each one be.
Tell me how you go take make am
The one wey belleful me pass na im go chop my 2 steem.
If I see another one wey my long throat go e fit still win something.
*You must upvote d post
Oya o where una dey we brothers, make you come see babe we be wife material. We sisters nko, make you come see man wey no Sabi manage o.
Na carry this one nak una today. Wetin you dey look am dey wait for? Abeg begin yarn jor.
Footnote
**If you would like to support us,
Please follow our curation trail Or delegate SP to account.
We are naijapidgin community with a mission to *promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows*
Join our discord severs for fun, interactions and voice shows VIA
We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.
On discord we have the following shows and lectures:
[Tuesdays by 8pm]
Lectures on Block chain, Steemit and Cryptocurrencies [Wednesdays by 6pm]
- Special Hotseat [Sundays 8pm]
Dont miss it
Naijapodgin Team:
The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain...