Good morning my naija people and the rest of the world. How una dey? Today na Thursday and na dey bring another beta come una way. Oya now, hope you dey ready to follow us yarn today.
Na true say dey talk say nothing wey eye go see wey go make am see blood but e still get somethings wey eye go see mouth no go fit talk. Children nowadays dey break person dey heart. Many people no want born girl pikin because e dey give person heart attack when dey begin dey mature.
Wetin make me dey talk all these one? Na wetin happen yesterday for night for my area. E get this small secondary school wey Dem dey call Linda. Linda no go pass 13years if I no mistake but this girl no dey Sabi greet person. Every evening, she go carry Jerry can go fetch water na so e go fetch one before she come back, day don dark finish. E get one woman for the compound wey dey notice say anytime this small girl go fetch water, one guy like dat dey come help carry the water.
So that yesterday as she don fetch na so the guy come help am carry am o. The woman come dey peep make she see them where dem dey climb staircase but she no see them. Na so she go check come sight them for under staircase. She run go call the girl mama and her siblings make dey come see wetin eye see wey mouth no fit talk. All of them come run come go check under the staircase. The woman point her touch. Na there we see Linda hold wall, Bobo dey back dey panel beat am. My country people, the whole neighborhood nobody wey no come see with their eyes.
My people, abeg wetin una get to yarn for this matter?
Wetin dey happen to our children nowadays?
Footnote
**If you would like to support us,
Please follow our curation trail Or delegate SP to account.
We are naijapidgin community with a mission to *promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows*
Join our discord severs for fun, interactions and voice shows VIA
We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.
On discord we have the following shows and lectures:
Lectures on Block chain, Steemit and Cryptocurrencies [Wednesdays by 6pm]
Special Hotseat [Sundays 8pm]
Dont miss it
Naijapodgin Team:
The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain...
|
|
|
|
|
|
|@
/DQmcu9FzGukGzVMZQhqhmw4NC5NxbetH6tzFSVBoGkNP1LL/IMG_20180319_092844_398.jpg)
Avatar designed by