My con3 people, i fundamentally hail all of una, both soul and body.
I wan follow chook mouth for this secondary school tori yarn.
Inside the year 1915, na when my alma mata, Etinan Institute for Etinan L.G.A for inside Akwa Ibom been born.
I no been dey too like book like that but i been pass exam well well becos say book where no dey gree enter head, must follow enter exam hall and because say i been too dey pass, na so my Christian Religious Education teacher been start to dey ask me questions any how for him class..
Him been dey always tell us say him be our shepherd and we na him sheep.
Na so him com one day, com dey teach about fornication, say na sin.
But na de same teacher where no dey allow all the fine fine girls for class to rest.
As him been dey teach dey go, na so me i carry hand up to ask am question.
"Yes! David, whats your question" for him deep voice.
Me stand up jejely, clear my throat, then shoot am my question
"Is it good for a shepherd to take out the breast of his sheep and suck"?
Na so class take dismiss that day because of my question.
Make una follow reason am with me, e good make shepherd dey comot him sheep breast dey suck?