
Omo, Medical school hard for boys. It's hard for girls but I swear sey Ih choke boys like yam. Ih choke boys sotey boys gas get extra space for hostel because we too dey repeat. Abeg before feminists come dey shout equality for here please note that I just said that in courses that have to do with direct relations with people women are doing better. That's nursing, teaching medicine.
But if na all those stressful under sun work like engineering, nuclear physics and the likes na men get am. Apparently, women are more interested in people and men are more interested in things.
But weitn I dey try talk be sey men like me dey suffer for medical school. And if you know the kny suffer ehn, You go dey pray for us steadily.
One of the reasons I think women do better in these courses is that they have better language understanding. For some weird reason I have observed that women can know names more than men. But I'm using myself as a case study. Just yesterday I met a super important person and told myself I wanted to remember his name and totally forgot by the time I walked out of the room.
I just dey free-write sha. But it is worth knowing why men don't do so well in medicine. I might conduct a study when I'm ready and I have the money.
Anyway, I thank God I'm almost done with this phase of my life. I dey wait result sha. But unlike most other years I'm optimistic about the result. After now na Doctor Ebingo them go dey call me.
Hope sey unah no go too vex, for one month I wan make everybody dey call me Doctor so I go dey use to am.
PEACE EVERY ONE!!
