My people for @HiveNaija I greet ooo, so I say make I come give my own part of my tory for pidgin but my pidgin fit no heavy as e suppose to be but anyhow make una collect am like that.
So my story na real about me and that time of my age wey we dey call youth exorbitant.
Na so I sit down, sit down, I say me wan stand. When I talk say make I follow wear that thing wey, everybody dey follow wear wey dem dey call for Oyibo shades abi na sunglasses, I no no the name sef. Na so I comot my money go follow buy dis thing ooo, thinking say na shako I wan do, I no no say na trouble I carry oo.
The D-day reach wey be Sunday wey I wan use my eyeglass do shakara oo, my people, I dress up with my best cloth oo, wear my shoe, carry my bag and my eyeglass sey if I reach road, the kind shakara wey I go with my eyeglass no go be small oo.
I reach road, comot my eyeglass from my bag wey I put carry go my eye omo I no fit explain wetin come dey happen to me oo.
As I wear the eyeglass, I begin to see things for ground two-two ooo. I begin to count my step they waka. E come be like say I dey climb staircase oo but I no gree remove am on to say I wan follow my age mate do shakara.
For my mind, I dey cry oo but base on say I wan become the center of attraction that day, I still dey wear am ooo.
I safely reach church with my glasses but the thing no reach me, I wan make my friends see me today and tell me say my glasses fine oo if not my day no complete o. na so I still dey waka ooo, I don forget say my church get staircase oo na im I climb the first stairs, nothing happen, I say make I climb the second one, I begin to see things two-two. The staircase turn into upper and lower case oo na so I put leg for the second one no no say na my imagination oo the next thing wey I hear na my body for ground.
My people, nobody tell me say make I comot the thing, immediately I stand up from the fall, I turn nobody dey watch me, na so I comot my glasses jejele put inside my bag carry my self and my body enter church. since that day till today, I no gree test that thing for my face o.
This na my entry for this week challenge wey make we talk story for pidgin.