I dey hail oh @HiveNaija. My name na Evelyn Moses David but I dey bear for Hive. I dey new for dis community and na
na him invite me to come dis group and I thank am very much for this invite. As na Naija group so I say make come talk and discuss with my people for dis platform for pidgin. This na the forst time wey i dey try write for pidgin so e fit no comot well but anyone wey mistake dey, do well to correct me for my comment box.
Naija na my country and I dey proud of my country. I come from Nigeria but I be Akwa Ibom person. I be the first and only girl wey my mama born among three children wey she born. I dey black, tall, and lepa and God come give me bulgy eyes join. Me I dey proud of am jhare. I like am like dat.
This na my people oo, na dem dey give me vibes. When I dey with dem, joy dey full well well. I suppose say one of the reasons wey I join this community to come to meet and interact with my Naija people wey go welcome me and make me feel say I get people here and feel at home for Hive. I love family and family sef dey important so I wan make new friends for this community wey I go fit dey chat with them freely and steady.
I hope say I dey welcome for this community and I hope say I go meet my Naija people for here.