Una weldone ooo, I don carry my leg waka enter Hive. My name na Wakky Paul I be the CEO of Wakkysignatures a place were them dey do all kinds of branding and packaging stuffs.
By the grace of God I be 29years of age and I come from Nigeria, I dey happy to come from here.
How I take waka come here(Hive/Hive Naija)
I been dey church one Sunday like that for August were just passed few days ago, one of my nigga come tell me say e get platform were dey oo say I for dey advertise my product for there say e for make sense Wella. He introduced me to hive, help me sign up and show me how to take explore the Communities and weytin all the Communities stand for.
I no get much interest but when tell me say community dey were be #hivenaija Community, my interest come rise.
As I don come, I promise una say all my things were I go dey drop here for una say e go be original from me and my company.
I hope say una go do make my body sweet me as my nigga been tell me.
I want beg for una help, say I be new person here.
Once again I greet una.
I go see una later Sha
I been .
Thank you.