Ok my beloved people i don come again o.
E don tey i never hear from you guys
I dey bow apologize as i been no fit relate with una for here and i salute everyone wey dey here dey make the community dey lively.
I go do my best try join una as everything na small small.
I hear say today na the final day for our "Pidgin Contest"
As i no wan miss am, na so i say make i come join una and drop my piece. I hope i no go bore you.
Pardon me as i no too fit speak Pidgin as i no grow up for Lagos hehehehe. I sabi say people for that side dey flow with pidgin. We here we dey struggle with it o hahahhha, but at least i know say i don try as Nigerian pikin; flesh and blood lol.
Now to my story;
My Pidgin Story
My people! My people! no laugh o as i wan share my predicament o for una, but even if una laugh abeg laugh small small.
So you see i no be this outgoing type wey be sef i dey go for countless dates and sitouts. I dey dislike crowdy and open place wey too many eyes dey look you like say you get shit for your face.
One day like that i kukuma summed up courage and na so i agree say i wan sitout with a friend. He talk say e wan go Dechoice o; a renounce eatery for Akwa Ibom; Uyo precisely.
I been drag with am for a while say i no dey like that place because of the crowd wey there thier but him talk say i will be fine.
Like play like play i don waka go eatery with this dude o. Unto shy type na, i sidon fold my hands as he wan go order something for us.
Him ask me wetin i wan take, and i tell am say na ice cream and meatpie unto say i no fit chop rice and chicken for place wey the crowd dey like market heheheheh.The ice cream and meatpie don arrive o but to eat am na problem.
But small small i start the chop the meatpie and take the ice cream.
Gheng! gheng! it was time to go o. Abeg who follow sabi say in eatery them dey get two doors; one for entry and the other for exit?
My dear brothers and sisters na so i go disgrace my village people o and the dude that even took me there no help matters.
We stood up to leave the eatery, and the wicked guy, i call him wicked cause him for waka for front make i follow am but him leave me make i go front go disgrace my ancestors o. Na so i waka jejely wan commot for entry door o, the security man kuku point hands for me like say him be compass. Without even saying anything the wicked dude for my back grabbed me and ushered me to the right direction o, see as people been look me. For their mind i be "UFA IWA" (New Dog) for eatery. But no be like that na, na shame and shyness for crowd dey kill my vibes of ever daring that place. I prefer to buy and take home than to sidon for there chop am, no na, i no fit.
After that day i never wanted to enter that eatery again. I rather; you order and we take am somewhere else. I no fit try that kind thing again, i been dey feel a little embarrassed and i no dey ready to feel that way again heheehehhe.
This is my entry for the week's challenge. I hope i am not too late.