This is one of the stories I heard when I was little. We lived in a compound filled with people and children so most times at night we gather to sing songs and tell stories and this was one of it but then I am putting it in pigin English. Enjoy!🙃
One day, Tortoise hear say Lion dey do big birthday party for forest. Dem say food go plenty, rice go reach heaven, and jollof aroma don already dey trend for bush WhatsApp group.😅Tortoise wear him best agbada, spray perfume wey fit wake dead mosquito, and waka go the party. But gate people stop am.“Who invite you?”Tortoise smile, “Me? I invite myself. I be VIP - Very Important Pikin!”😏Dem pity am enter.
As food reach table, Tortoise shout, “Make una no rush o! Table manners first!” but before anybody blink, na him spoon first enter cooler.He chop rice like say tomorrow no dey. Meat wey suppose reach ten animals, disappear like rapture.
Monkey look am say, “Tortoise, you no dey shame?”Tortoise reply, “My brother, hunger no get respect for shame.”😂 (ahbi no be so?)🤣
After food finish, Lion announce, “Anybody wey no bring gift go wash all the plates.”
Na so Tortoise freeze ooo....🤣 Dem hand am sponge and bucket. Na so our oga wash plates till night, singing, “If I know, I for carry pure water come as gift.”
Uwoooh!!😂
Oya
Mak una come yard una storey😂
RE: Sam’s Hangout #82 -”STORY TIME”