The matter don taya mi honestly
How una dey my people, I don here am and e don dey trun my belle as e dey go.
This awa 2023 election race done dey close but some people don dey use sand for the garri with their small thinking already.
Election na something wey everybodi suppose join hand take put people wey get better plan inside Aso Rock and other worthy offices, but as e dey be, na only magomago some dey use enter the place. THis one na wetin I go call Magocracy. Because Magomago goverment by magomago pipul for magomago pipul o.
As e dey be, na so them hire different Cloaks and plenty people say make them come wear am because of religious acceptance of a muslim muslim ticket. E don burst o, as we done sabi se, this people follow one road come, follow the same road comot, na to collect package remain o.
E done pass 6 months now wey Government Universities no dey work o, becasue ASUU still dey strike, people dey house dey hive, school no dey, work no dey hehehehe.. Na to dey run street remain for boys like this, I remember when I been dey school tha year, I carry good result go house, by the time strike finish I no sabi anything again. Na which kind graduate we wan produce, after them go talk se we overage for work wey we suppose do.
4 yr course na 8 years them dey use do am for Nigeria, if you come study medicine , na there you go dey, your mates go marry finish.
On top another matter, fuel price no dey one place again o, na different price from on efilling station to another o, infact, e be like select and pay now o, na you go say wetin you want and where you want buy am, 170 per liter dey, 175 dey 180 dey, 200 own sef dey. I come dey ask myself se, wether na d same fuel o abi one strong pass the other?
Make a off my mic for here the matter plenty but I go dey bring am come small samll.. Nigeria go better.