Hello everyone, I will be introducing myself with pigin. I just want to be and express myself in a way I feel more comfortable with.
First of all make I greet una my country people for steemit. E dey sweet me say today I dey do am dey naija way.
My name na Queen, I be better Akwa Ibom girl. As e dey so now I dey study microbiology for University of Uyo and I be the last pikin were my papa and mama get.
I sabi play drums and football o (no try me, I go dribble you 😂).I the believe say steemit go give me that chance make I showcase waiting I get.
Na my friend been yarn me about steemit. Since I know that guy, Na the first better thing him don carry come my way.
I salute you, your girl still dey loyal.
I also throw-say salute give aunty for wanting she dey do for us for steemit. I pray say one day I go fit see am eye to eye. I also throw-way salute give daddy
, him too much. If no be because of am I no know where I for dey. God bless you
.
Finally my plan for this steemit for now (I no know as e go be for future), Na to contribute better better things to this community, make money, and then dey enjoy myself as I dey do this things......