It’s been a beautiful day today and this day has been blessed with a post by .
Oh well, given the opportunity to contribute and personalize her post, I am happy to do so.
The NPC Challenge is right below the English version.
No lies, until her post, I never really knew what a creed meant, but today, I discovered that a creed is a set of beliefs or aims which guide someone's actions.
 wey I wan share with Una
Na Wetin me believe self?
- I believe say everyone deserve second chance
- I believe say make we dey reason matter wey our action go cause before we begin do am.
- I believe say everybody get en own quality wey sitdon yafu yafu for im body wey make am dey different from im padi dem.
- I believe say everyone get im own way to choose weda make im bad or make im good.
- I believe say everyone get the ability to hide im character wey no good.
- I believe say everyone wey dey this world sppose get the same chance wey im fellow human being dey get, even if the problem wey ground boku.
- I believe say when person suffer for something, im go see the value wey that thing get.
- I believe say everybody wey dey this earth dey equal, because we all go still die enter where we no expect and our money go sitdon gedi gedi for here.
E dey good make we realize say everything wey we do go give us result. Weda na better or wowo result. Pikin wey dey cry, na something naim make am dey cry and that man wey grow turn bad person, na something naim make am so oh.
Before you begin dey yab your padi man, make you try know wetin happen.
Before you begin they curse person, make you reason matter wey dey ground.
E don tey wey me gree say e good to dey tell person well don for the better thing wey e don try do, weda that thing make sense oh, or e no make sense. Because I don grow know say person wey try do something wan really am well and to tell am well don, go ginger am..
Okay, This wasn’t easy at all!