My good people, una good day oo.
I no know if una don hear about the weli weli noise of Black Panther. Na so so the film dey make plenty noise for my dormot. Infact, na the weekend wey pass na hin my friend and I for go watch the film for cinema house but we no fit go because time don go.
Shey una hear say five Nigerian acts dey for the movie; I no say that one no be news again.
Shey una hear say the culture of the Southern and Western part of Nigeria dey for display inside the movie. Infact, they wear agbada for the movie sef.
The koko of the matter be say in case you no know before, that film wey dem call black panther don dey break many many record ooo for box office.
Na beg I dey beg oo if you don watch black panther how you take see am ?….shey the movie worth the talk ni abi na only noise them dey put for hin head.
Yawn me make I hear abeg. Naso e go be for now.
20% of this post payout go go to the person wey him comment get enough people dey follow am argue inside and the one wey get plenty upvote.
Na format and edit this pantherlized post wey
write for our ogbonge
.
If you go like join us for Telegram, click here