Source
My pipo my pipo!
TGIF! I know say una no fit wait wey weekend come, e don show, make una flex with caution o
E be like say relationship na one better way to take die. Wetin i mean be say if person wan die, make the person no go do suicide, make e kuku enter relationship. Because i no understand the way wey people dey take kill their lovers. Na wetin full for news now.
Na so police people find Khadijat Oluboyo dead body for e boyfriend Adeyemi Alao, house for Akure. The girl na Ex Deputy Governor for Ondo State pikin. And na for under bed them see the body. They arrest the boyfriend but e talk say no be him kill the girl.
E say him and the girl don breakup since 2015, but they just start to talk after Ramadan. E dey help the girl write project for school, the girl come e house tell am say e wan receive visitors. later 2 boys come to visit the babe, e give them space. E no reach 30 minutes, one of the boys come call am, e see say the boy hold small gun, the other boy dey ontop Khadijat, come strangle am. Dey threaten the boy make e no talk, even force am to dig the ground wey dem put her body for under bed. The body come begin dey smell after some days and the boy no fit sleep, as e dey plan to throway the body, police people get the information, come arrest am.
But people dey believe say na ritual wey the boy carry am do. I believe say, police go chook eye for the matter wella.
How boyfriend go gree make e girlfriend carry guys come e room? Where dat one dey happen?
Abeg make una help me reason the mattero..
Wetin una think? Una think say the boy dey talk true?
Yarn wetin una think make i hear..
I wan advise us say, make we dey careful o, for the kind people wey we dey follow. Make we no gree make love cover our eye o, na only one life we get. Na person wey wear shoe dey know where e dey pain am. If you know say the shoe no gree you walk, abeg commot am, your size dey market..
Footnote
**If you would like to support us,
Please follow our curation trail Or delegate SP to account.
We are naijapidgin community with a mission to *promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows*
Join our discord severs for fun, interactions and voice shows VIA
We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.
On discord we have the following shows and lectures:
[Tuesdays by 8pm]
Lectures on Block chain, Steemit and Cryptocurrencies [Wednesdays by 6pm]
- Special Hotseat [Sundays 8pm]
Dont miss it
Naijapidgin Team:
The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain...