Good morning my country people. How una dey? This na another Thursday for naijapidgin. Before i go to the matter wey dey for ground, abeg make i ask una how una take dey hold body for this weather. The Kain rain wey dey fall everyday for asaba no be here o and na so e dey carry cold dey come. I don drink tea tire tea no work for me again. I jealous people wey don marry. Na them get this season. Chai!
Anyway, make we dey carry on to the matter wey we get today. Strange thing dey happen sorry even animals now want become first class graduates. I no say some dey chop book but now some of them don dey read as in dey don dey study am. I no know weda recession wey dey naija don still reach animal kingdom.
No be everyday you go see cat follow students dey study but na exactly wetin happen for the popular Awo Hall for Obafemi Awolowo University, Ile ife, Osun State na im i dey yarn you so. One Facebook user wey Dem dey call Adeoyo Sunday na im carry this matter come Facebook where he post pictures of the car where e siddon on top bench dey study seriously with book wey e use im leg pin on top bench for the University. As students go the Awo Cafe to read na so the cat follow, find im own space come dey turn the pages of the book dey read jejely. Na for OAU Facebook group na im dey share the photo come title am, "Even in OAU animals do read, imagine a cat reading in Awo Cafe".
My country people, e be as e get o but me go leave una judge the matter by unaself. Some call am endtime cat, wetin you feel? Abeg yarn us make we reason this matter together.
Na carry this one come una domot today.
Footnote
**If you would like to support us,
Please follow our curation trail Or delegate SP to account.
We are naijapidgin community with a mission to *promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows*
Join our discord severs for fun, interactions and voice shows VIA
We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.
On discord we have the following shows and lectures:
[Tuesdays by 8pm]
Lectures on Block chain, Steemit and Cryptocurrencies [Wednesdays by 6pm]
- Special Hotseat [Sundays 8pm]
Dont miss it
Naijapodgin Team:
The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain...