My Naija people how una dey, I trowey salute give una oooo.
And I welcome all of una to our ogbonge naijapidgin blog.
Today na Tuesday so make una use am make up for work wae una no finish yesterday Monday
Wetin dey happen? Relationship nowadays don be like football wey dey get many players. Everywhere you turn na he cheat on me or she cheat on me.
Na so kasala burst for my area yesterday when one guy catch another man ontop him woman. Na so fight scatter everywhere.
So today I want make we yarn this matter.
Dem don cheat on you before?
Wetin you do when you find out?
Wetin be the best revenge to give your partner wey cheat on you?
Abeg make una shook mouth for this matter as e dey hot. We go like hear wetin una opinion be.
Today na birthday make una help me wish her happy birthday too
Make una come join us for our Whatsapp group by 9pm
If u neba join click here