I greet una my country people. How una dey today? I trowey salute give una o. We don come again but before we yarn today matter we go first announce people wey win our recharge card yesterday. Their names na ,
,
and
. Una congratulations o.
I no say una go like make una win too, oya follow today Tori.
Today we dey talk about lie wey dey scatter brain. E get some people wey if dey lie give you, you go know say devil na learner. Their lie fit make you run mad. We no dey talk say lie good o, but we just want use this one learn the kind yeye lie wey people dey lie.
Oya wetin you go do?
- Go comment section
- Talk one bad lie wey you lie
- Talk wetin make you lie that kind like
- They catch you for the lie?
Person wey im lie get highest upvote and comment inside before 7pm this night na Dem go win our recharge card this night for telegram by 9pm
How you go chop that recharge card
Join us for out telegram group here na there we go talk who win the recharge card and collet your number
Na bring today tori for us and na
edit am