My naija people I hail unah o.
Make I great unah Wella because e don tey small wey we yarn together for this our community, make unah no vex nah because we dey try arrange this our house as e go take better for everybody and how we go dey contribute to this our community but make unah no worry now we go dey give unah Tori everyday back to back.
image
As e dey be eh.... Today we get ogbonge Tori wey we want make we for shook mouth put. As I dey yarn unah so eh another one don happen again o. Just 3weeks ago we been dey talk about moni wey snake swallow, e Neva vomit am nah him our APC gomenti don come outside with another Tori say monkey don swallow 70 million.
Abeg my country people, make I ask una this question. Abi we country don turn zoo wey animals go dey terrorise us abi moni don turn animal food?
Why be say our yeye politicians think say them fit take us play ten ten? Wetin dey even pain me be say nah one northern senator we em name nah senator adamu Dem say carry d moni put for em farm before the monkey swallow am.
Abeg wetin carry 70 million go farm before monkey come swallow am? Who get the monkey? How the monkey mouth big reach for am to swallow that kain Moni and how many hours e take am to swallow am?
This our country matter don tire me, 70 million no be beans o. E b like say this our politicians think say we no get sense, them no dey even think before them talk give us
My country people how unah take reason this matter? Wetin go fit stop this nonsense wey the dey happen? Wetin b d solution and way forward for this our country naija.
Abeg make we shook mouth put and make we no forget to make make am short.