My country people I trowey salute give unah
How unah dey, hw una dey rock sunday for ur side
How unah take the hold body for this we change?
We no say ground dry dat nah why we go continue to d pray make things dey easyfor all of us
So make I officially say good morning gee to all those wey d read dis post this morning, today nah another beautiful Sunday and nah also start of another new week and as we d prepare to resume our weekly parol make we no forget to go church and to we Muslim brother make we remember pray too
As we d do am before before…….
As unah know every Sunday for nah for contest and today we wanna announce result for the contest wey we host last week so that we go fit nack dem their prices
But before I announce d winners I wanna first of all thank unah wey don dey support us since d day wey we start, those wey join for road and those wey go still join UNAH TOO MUCH if no be because of unah we no go fit dey here so.
nah we get am and make unah no forget to always dey support us
Oya Back To D Matta
Nah 19 pipu enter d contest for judgement and make I no lie give unah all d story make sense die, we enjoy sotey we laugh forget ourselves, nah so d thing make sense we no come know who to choose but unah know as competiton d be…….. no be everybody go win, so if you participate and you no win make you continue to d try one day baba God go pick your call too
just say make unah know
All d winners wey d judges select nah base on d rules we don dey ground for d contest
D rules nah
1. D title must b blind date
2. You must get upvote for d link wey you put for d comment section
3. You must use naijapidgin as tag
4. You must upvote d post and resteem am
Base on all things nah em winners show
Announcement
so people wey win nah
1st nah …………………………….. 5sbd
2nd nah …………………………..4sbd
3rd nah …………………………….3sbd
Then people wey win our 1sbd nah
We say congratulations to people we win!!!
Until we show unah domot again……….. dey say thank you