My country people I trowey ogbonge salute for unah
How unah dey?
How unah take the hold body for this we change wey d touch everybody so?
Make unah no worry I know after every every better go show
So today I want welcome unah to our ogboge naijapidgin blog and as unah know today nah another beautiful Sunday and we Don arrange another better package for ourselves.
But before I yarn unah the Koko
Make I first use this time thank all of una wey don dey support us since the day wey we start, if no be because of unah we for no dey where we dey so, if I look back see d things wey we Don achieve together the followers, the upvotes and the WhatsApp activities nah so so joy full our heart
Abeg unah too much
We say thank you
So today we want do small thing we them dey call "send us your message" and nah for weather you b christain or you b Muslim
Wetin e mean b say
You go go the comment section, upload your fine today outfit as pishure
Then write your short best motivational message and send shout-out to anybody wey you want send
Make e no pass 100 words
The person wey quote and motivation make sense pass go win price
Note: the admins get right to change the rule of today and d price anytime
for example
My country people I great unah my motivational quote for unah today b say no allow anybody make you look less of yourself make nah you go decide you own happiness
I want send shout-out to all the admins of .