Aha my people, una very good morning o. Today na Sunday and yes na contest Sunday. Oya begin dey joli. Yes o, nothing do you. Today na Sunday and na beginning of a new week. Una know say during the week, we win 500 SP delegation from and body still dey sweet us.
In the spirit of jollification, we don decide to host ogbonge contest. I know say una like contest but who knows like better thing? Na so now but no forget say awoof dey purge Belle o.
WETIN D CONTEST BE ALL ABOUT
E easy well well, we want know those of una wey dey very creative and wey fit make person laugh piss for body.
So una go write on this topic, "Blind date experience". Una Sabi wetin be blind date abi? If you no Sabi ask your neighbors.
Wetin we want make you do?
You write on the topic, "BLIND DATE EXPERIENCE" for your blog then you go copy the link come drop for here for us.
You go gather people to come upvote that your link for you. You go must get 10upvotes from people to qualify. No worry 10 upvotes easy to get.
You go use #naijapidgin tag so we go fit find you.
You go upvote this post and reesteem am.
Na so, e don finish.
How we go choose winners
We go check weda you follow the rules 1-4
We go check how creative your work be.
We go check how funny your work be and how you take speak the pidgin well even use appropriate pidgin proverb join.
We go check weda na copy you copy abi na original work.
AWARDS
1st winner go carry 5SBD
2nd winner go carry4SBD
3rd winner go carry 3SBD
E remain 3SBD abi? We go share am between 4,5,6 positions. You see? You must win something if you try your best.
JUDGES
Na all the admins go judge this contest
Oya wetin you dey wait for, carry go p jaire.