My country people, una very good morning. Na dey hala una dis morning. I hope una wake up for the better side of bed. Morning don reach and hustle continues but for some of us wey be student we get news for una o.
Yesterday, news reach us say the Federal Executive Council talk say make no federal University dey pay school fees again wey una dey call tuition fees. E talk say the law no allow am although I come dey wonder weda na now dey wake up see that one say law no allow am. Anthony Anwuka wey be the minister of State for Education na im talk this one where he dey brief State house correspondents after the cabinet meeting wey Dem hold with our Vice president, President Yemi Osinbajo
The Minister talk say Council talk about all the ogbonge school fees wey students dey pay for school come talk for we law, no federal University suppose dey tell im students make Dem pay school fees.
He still talk say all those yeye yeye fees wey Dem dey pay like course registration fee, departmental fee, I remember fee and I no remember fees say all of them must stop say na only small small money students suppose dey pay and if Dem catch any University dey charge pass wetin council don fix for students to pay na im be say gbege don land and wahala don wear sokoto.
This matter na only federal University e concern o. If you dey private University or State University, na OYO be your case o.
But my people, how una reason this matter? No be campaign strategy be this about government just dey wake up?
We know say if you no pay school fees you no go write exam, una sure say this their law go fit work?
Where school want take get money run their matter? This one no be axe govt dey place for iroko tree wey dey no know which side e go fall?
This one no be matter of I dey shame, I dey shame and you go dey kpeme for silence, abeg open mouth for this matter. If you no dey school, you get you get one wey dey school.
You don join our WhatsApp group
Na design this avatar for we.