My country people, una goodmorning o. Today na another Thursday. How the weather be for una area because the Kain heat wey dey sama me for where I dey eh, I neva go hell fire before o but if this one na small idea of how e be, I no sure say I want go there.
Unto the matter wey concern us. This week many many things happen for we country and we don try to bring am come una domot this week. If you no dey follow us before, make you check we blog dey updated.
Today, we go talk about our ogbonge president, president Muhammadu Buhari. Wetin he do again abi? Yesterday, Voice of America interview am and he talk many many things.
Buhari talk say before wey he be military general he dey give orders but now as civilian governor he dey receive order from people. Although he no talk who he dey receive order from but make una look am well, he dey run dis country like civilian president abi as military president?
As Dem dey ask am dey go, he still talk say wetin make am want come back for second term na because he get unfinished business especially for the area of security. Our president talk say Boko Haram still dey use small small girls dey force Dem dey carry bomb go dey blow churches, mosques, parks and even markets. He talk say Dem still dey sambisa forest but the Nigerian army dey prevent them to come out.
Abeg my people, this Boko Haram, who dey sponsor them dey give them their better better weapon and how e take dey reach them?
Una believe say Buhari dey try him best to solve this problem and again he no fit do am now na second term he go take do am?
Na carry this one come meet una this morning. If you never join us for WhatsApp, you dey miss o, oya touch here