My naija people Happy Valentine's Day!
I hail una o.
We don land again with valentine special.
Una know say we don too talk about government, so we come decide say make we talk about this life wey we dey so
Una know say na love season we dey so, and na Mama love wey be highest after Baba God.
You know say if you start to dey think wetin your mama don do for you, you no go fit count am.
Walahi, the suffer wey she don suffer to make your life better.
Some people, their mama dey even sell market for sun, to pay their school fees. Our mama dey try wella!!
Na so you just dey one day, you come see or hear say person slap your Mama, chai!
Wetin you go do?
If the person old pass your mama, that is if na elderly person,
How you go handle am?
If the person na young person,
How you handle am?
What if your mama come dey at fault, and you dey do born again
How you go handle the matter as born again wey you be?
Make una help me answer abeg
Abeg make una help me reason this matter. Make una try make am brief!
Our discussion go continue for our telegram group. Remember say na there everything dey happen. If you never join, join here.
Our admins don decide say na dis people qualify to collect 50% of our liquid payout for the last post. ,
,
,
and
.
If you wan join begin follow make this kind decision, join us for telegram for here. We go dey start discussion around 10 pm everyday. But we fit adjust time to any one wey una suggest.
Na choose dis topic wey we discus so. So, 5% of the liquid payout na his own. If you wan win the next one, join us tonight to discuss wetin our next topic go be.
Walahi, E no easy to pick this winners because everybody yan better for dat tori. We go dey use our telegram group to decide better.
Five people wey yarn correct things here go receive 50% percent of the sbd wey we go collect from this post.
No mind say ein small now, very soon e go big well well.
Abeg remember to follow this account, upvotes and Resteem.
Na for telegram we go dey choose our topics. First person to pick topic wey others agree with go get 5% of the liquid payout.
Abeg all the naija pidgin lovers make do quick quick go join the telegram group for here.
Our Telegram: naijapidgin
Oya make una yarn am as e take be for una mouth.
Una doh o!