The principal for one government technical college wey dey for Abak for Akwaibom state wey dem dey call Friday Udoka don dey beg since say make NYSC and nigeria forgive am for the bad thing wey he do give one female corper wey dey serve for him school wey dem dey call Olaitan Adeola Kolawole.
Source
As he dey beg on Monday for NYSC state office for Uyo, he talk say no be say he dey like to flog well well na im make am flog the female corper say na anger na im cause am. He talk say on that day, Miss Kolawole go write her friend name wey dem dey call Dolapo for attendance register when she know say the corper no come school. He say he don warn them tire make dem no dey do so but dey no want stop. That's way as he see wetin she do, he Waka go the class wey she dey teach, flog am come drag am out of the class Infront of the children.
Untop repentance levels, the principal say as he reach house na im he reason am well come see say true true he overreact and as she be woman he no even suppose do am that kind thing na im make am come dey beg say make Dem soak towel for water put am for their heart make e cool down. He say he no go ever try am again. He say make she go hospital say he go bear the cost of any amount wey hospital go charge am.
Miss Kolawole come reply say wetin happen don happen make dey allow dog wey dey sleep make e sleep. She say he na elder and if elder apologize to small pikin , small pikin suppose accept am. The commissioner for Education wey Dem dey call Victor Inoka come look the matter finish say as Dem dey don make peace and as Miss Kolawole don promise say she go beg her parents make they no carry the matter go court say he go give her N50,000 make she take go treat herself.
My country people, how una see this matter? If na you be Miss Kolawole wetin you go do?
Una good morning o my country people. How una dey this Tuesday morning? Hope body dey kampe? Make una dey take life jeje o. One day God go bless our hustle.
If you like what the community is doing and would like to support us,
Please follow our trail via
Or delegate SP to .
We are naijapidgin community with a mission to 'Promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows
Join our discord severs for fun, interactions and voice shows VIA
We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.
On
discord channel, a lot of variety shows and lectures are ON
- Every Tuesdays we have real life issues with
- Every Wednesdays are unavoidable lectures
- Every Thursday we have relationship talk with
- Fridays is our well known ameebo center by
- Sundays is always variety night show by
and
.
- Same Sunday we have our
hotseat ( featuring some well known steemians)
You ought no to miss any of our programs.
TEAM:
The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain...
|
|
|
|
|
|
|