👋👋👋👋👋👋👋👋👋👋👋👋👋👋
My naija pipu, beta pipu, correct pals, hw una dey.
Hw una weekend dey take be, hope say unah enjoy d free day of d week..
talk say make i grit all of unah "good morning " say im dey wish u a stress free week ahead
How hustle, hope say na pray n work u dey carri all dis level do. We pray say all go sama well veri soon.
For dis kind gentle morning wey i don dey plan my daily activities, na im i hear one kain noise for my neighborhood, my head for turned around say which kind wahala be dis. Na after i comot my room, na im i see say na relationship mata dey twerk ' dey sup' for d place.
Na relationship mata carry come our domot today, make una follow us reason dis mata bcos we don see say some marriage don dey too old. So hw we fit shuffle things 2geda....
👫👪👬👭
Wetin be relationship (marriage) self?.
Relationship na d union wey dey sup btw two pipu of opposite sex. As relationship dey, it works with marriage.
And we don see say marriage na d mutual agreement wey dey puyeke btw man and woman dat ar tied 2geda.
So d arising mata wey dey dis discussion be say some marriages don old wey be say na evriday quarrelling. Without polygamy self, dem no get peace, and divorce come be like taboo.. Nawa oo. Wetin man go do for dis kain country wey be say ur wife tire u. Instead say make u turn her to punch bag, divorce letter self pay pass all dis. Bt wetin dey pain me pass be say d wife go wan turn mario ,dey talk say na d father of im pikin get am.. Deadlock.......
views 🙋🙋🙋
Dis relationship mata wey dey puyeke for we domot no be new thing...
Wetin i dey suggest be say if naija fit stick to all dis yankee pipu style wey be say marriage go dey base on contract. Maybe 10yrs of marriage + 2 pikin, and if u see say u still dey happily 2geda, u fit extend am..
Bt dis kind thing get demerit sha bcos say for naija here, i swear bastards go full ground like sand..
As d mata don be::::
Ma naija pipu, hw we takr see am
hw we take reason am,
Wetin we fit do to solve all dis kain relationship 💍💍 mata.
Abeg make we cbuk mouth for dis mata..
No forget to join d whatsapp link via