My countri people!
TGIF, I dey wish una beta weekend..
Oyinbo people say health is wealth, that one na true matter. Nothing sweet pass better health. Even as i dey now, if my belle begin run me or my head begin pain me, I no dey get peace, na dat time i go begin reason wetin good health be and as e dey important.
Most people dey no dey fit burn pikin because say dey no dey treat infection.. Dem dey leave infection for their body till the thing go destroy one kain thing. The infection wey dey too common na Staphylococcus, most people dey carry am waka but they no know.
Staphylococcus na bacteria wey dey fit cause other infections. You fit get am if you dey share sharp object with person wey get am, through sexual contact or for food. E get some signs wey you go begin see for body, wey go show say you get staph.
For guy
- Your groin go begin pain you.
- To urinate dey pain you
- You dey get milky discharge for penis
- Around your penis dey scratch you
- Your testicle don swell up or e dey pain you
- Your anus dey itch you
For babe
- Sex dey pain you
- You get milky discharge
- Your lower abdomen and back dey pain you
- To urinate dey pain you
- You dey get fever/nausea
- Menstruation no dey regular
- Anus dey itch you or you dey get sore throat
If you dey experience anything wey dey dere, go tell your doctor make e check you make the sickness no spread. .
Any other sign wey no dey here, you fit talk am for comment, make we learn..
Na carry this matter come una domot today..
If you like what the community is doing and would like to support us,
Please follow our trail via
Or delegate SP to .
We are naijapidgin community with a mission to 'Promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows
Join our discord severs for fun, interactions and voice shows VIA
We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.
On
discord channel, a lot of variety shows and lectures are ON
- Every Tuesdays we have real life issues with
- Every Wednesdays are unavoidable lectures
- Every Thursday we have relationship talk with
- Fridays is our well known ameebo center by
- Sundays is always variety night show by
and
.
- Same Sunday we have our
hotseat ( featuring some well known steemians)
You ought no to miss any of our programs.
TEAM:
The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain...
|
|
|
|
|
|
|