Thank God say today na Friday. My country people I trowey salute o. How una dey? How una week? Hope nobody make una vex? Abeg anybody wey do anyhow make una show am anyhow.
Okay to the Tori wey dey ground today. I just come back from work na im I hear people dey shout o. They gather one guy just dey knack am left right and center. I say make I go know wetin dey happen o based on say make I still dey updated. Na so I draw near o see the young man as blood dey come out for nose, eye, ears everywhere o.
image
Wetin he do? Wetin he do? Na so I just dey ask before dey knack me the Tori o. Them say na so dey catch the guy dey put im thing inside one 2 years old girl baby thing. As I hear am eh, my brain scatter na so I join the beating o. Na them sef come dey hold me.
Abeg my people, wetin go make full grown man see small pikin wey no her breast, no get yansh no get anything and im thing go stand reach to do? Make una shook mouth put for this matter o.
This kind people so, which punishment you feel say na im dey deserve? If I talk my own eh, but I go let una talk una own first.
If you go like join us for Telegram to win plenty recharge card abeg click here
Na
carry this Tori come una domot.
Na
na im help us design this avatar.
Today na Friday o, party jeje