My country people I trowey salute for unah o,
How unah dey?
How unah take the hold body for this we change?
I know say anyhow yagayaga baba God still the help us push am jejelly.
We don come today again o, but as unah know as e take the go,
Today we want celebrate all of unah,
All of unah wey join hand the help us push this our ogbonge community go the permanent site.
“We say thank you”
All of unah wey the show us love for we blog, whatsapp, telegram and anywhere naijapidgin dey.
“We towale for unah”
Yes nah you….., nah you I dey talk about, that same you wey the always dey on standby wey the make sure say anytime our tori drop you dey upvote, resteem and comment back to back.
“We say you too much."
If no be all of unah we no go dey where we dey today.
Each time wey we sitdown reason when we start and where we dey now nah so belle go just dey sweet us.
“abeg unah thank you.”
Them say person wey no appreciate small thing even when big thing come em no go appreciate am.
So all of us for naijapidgin
our mama
Love of of unah well well.
We wish say we fit call unah name one by one but my ink go finish because the family don grow, but anywhere u dey just know say we love you and we celebrate you.
And abeg make we no forget say we still dey grow and only us no go fit doam for here so abeg make unah no tire to dey show us love, tell your friend make him tell em friend, infact anybody wey you know, so that we go fit get mouth for this place (steemit) and if we get mouth e go better for everybody too.
Them say naija no dey carry last anywhere dem dey highest nah draw.
So my people make unah dey push this motto make we carry dey go the permanent site.
Abeg make you no forget to upvote, comment and resteem so that we go fit get money dey give for we whatsapp.
Naijapidgin “unah too much jor”