Naija una well done o
How una dey hold body for this SBD saga
Naija pidgin don carry another ogbonge mata come come today!
Una know say some people wey dey live for yanke dey struggle to make money
Some of them they wash plate, while some na driver work dem dey do.
Some no kuku get papers, dem dey hide up and down, make their Government no catch them.
The thing be say, Life for yanke no easy at all.
But some of these people wey don suffer to make this money, go come back naija dey spend am anyhow to show everybody say them come from yanke.
but e still get good ones wey dey use the money do investment, build house or start company.
So i dey bus yesterday, one lady wey dey my back just dey make call dey shout,
E be like say e no too tey wey she come back from yanki
She dey send money give her sister wey dey naija to help her build house
but from the call wey she make, she go the house, come see another person wey they renovate the house
She come find out say her sister sell the house.
The sister no even know how the lady they suffer to make money,
She just sell house carry the money go.
The lady no know wetin to do, if na person wey no be her sister, e for easy to deal with am.
But as this one be her sister, she no know where to start
Naija pidgin make una help me reason the mata,
If na you wetin you go do?
Wetin una dey advise the lady make she do?
make una chook mouth for this matter for comment section
We get whatsapp group where everything dey happen, if no dey join here