My country people, Una welcome to this ogbonghe yarn corner were we go yarn about matter where concern us.my name na still @Sawphyire your one and only talknologist.
This relationship dey concern two person where be man and woman..sometimes en no dey lan for marriage because some women too too dey misbehave. When this man bin dey write love letter, dey buy you chewing gum and sweet,just to chyke you, you no see say en wicked. When you bin dey call am Hrtbeat, and your life,you bin expect says when Una brk up,en go go buy spare life for you from Alaba international market or from your village market. The major problem with relationship be say we girls no sabi wetin we even want.
How you expect guy or bobo to come fulfill marriage rite for your head when en never even drop Pepsi for your head. You go come carry your bag go stay with am dey fulfill wifely duties for am and en friends go dey call you wife material ,you go come dey misbehave. After you don Cook,wash,and clean for am plus confarm night food at least 3 rounds,wetin again you wan give am? You no sabi say you Don use all your girlfriend and wife material do rag give man? Girls Abeg make Una wake up, no allow guy use Una again... make we give ourself respect. No be every guy wan sleep with you,some of them wan woman were go better their life with advice,encouragement and prayer. So give yourself value So them go respect you and guys if you see say you no go marry person pikin,no mix hypo and omo wash her head like say na Ariel advert you wan use amdo. You fit help a sister for en weakness instead of using her. En fit be your sister.
For our small corner, we sure say you Don learn something were go upgrade you.
If this post knock you well,upvote, and resteem make another person follow chop wetin I give you chop.I dey hail for this ogbonghe opportunity to reach out to all my paddy were dey promote our Nigerian English.
From my side...I dey sign out.make Una flex.