To some pipu steemit na film trick, but to every steemian all over the world especially for naija you go comfam say steemit sure pass, e over make brain.
your head dy dia abeg, you too much!
Make i tell una my tori;
Afta the whole MMM matter una know as e go we no need make noise about matter, as e take happen anything wia get internet parols been tire me until one hot Sunday afternoon after church service, e be like say my prayer go well that day na xo i jam my guy for NYSC since 2016 na wen we see last baba God must to bless your hustle.
The guy brief me about steemit i bone d guy but wetin trip me be say the guy collect phone play play sign me up for steemit tell me say i go live to thank am.
No be lie i still dy thank d bros up till now because steemit legit die. Anybodi wer feel say steemit na joke that person dy learn because this platform sorry community na over sure dy worry am, i no wan talk bills wer i dn settle all thanks to steemit
Well for me i dn promise myself say i must to preach dis gospel of steemit, for those of us wer hia the gospel of steemit abeg no gree d fire quench... tell pipu about steemit.
steemit legit o
Na steemit sure pass!
God bless una hustle
baba you too much God bless
Abeg as you don read my own follow talk your own...
Foto: me my mama! My mama say she gbadu steemit say she wan learn