Na bank be this,na one of my favorite place oo,na everybody kuku like money,I no dey lie. Na bariga, Lagos this bank dey
How una dey my people o,I hope say una dey well?
Na organise this contest so, me don dey find way wey I go fit express myself for pidgin thay thay for this platform.
Steemit na blessing for my life ooo, make I tell una small Tory.
Me just wake up one day like that,come decide to dey post poem for my social media handle,na so the thing catch the attention of one of my Paddy. He talk say I fit dey make money with the poem wey I dey write. As I hear money,na im my ear open o,na so he Yan me about Steemit.
As I dey journey through Steemit,I think say make I just earn my money, mind my own business but Steemit no gree me.
Since the day wey I don join Steemit,my relationship with people don increase in quality oo,me wey no dey too mind other people before I come become friendly. Another thing be say Steemit don make me improve on reading and research work,as we all know say Steemit no dey collect anyhow thing.
Last last ,the money wey I dey receive from Steemit sweet my belle no be small. Me sef come dey independent.
My people ,na my Steemit story I just yan una so